Friday, October 16, 2015

SENATE DON SHIFT REMAINING SCREENING GO NEXT WEEK TUESDAY

Shebi na yesterday dem suppose do the remaining screening for pipu wey Sai Baba nominate make dem become ministers for Naija. But we hear say we Oga Senators don shift the remaining mata to tuesday next week for the rest pipu wey be like 10, from inside dem na him we get Rotimi Amaechi, one of the pipu wey spend money pass for APC Campaign, wey still be former Gomina for Rivers State and Oga Adebayo shittu from Oyo State. So make we siddon dey see wetin go happen next week tuesday, make Baba God no kill us.

No comments: