True to God, I no go but I hear say the show make sense die for Jogor Center, e no be like the last one wey glo do wey dem no see pipu come watch am. Dis one dem say pipu plenty die, na so artistes too make plenty brain; Saheed Osupa, Korede Bello plus beta comedians like Seyi Law, Bovi, Bash plus including we beta pikin for Ibadan Rapindaddy scatter the place. Dem say pipu laff so tey dem dey piss for body. Na so we make brain wella for Ibadan, we dey support pipu, na only cheating and insult we no like.

No comments:
Post a Comment