Saturday, October 24, 2015

SCREAM AWARDS 2015 DON DEY SHAKE SOUTH WEST OF NAIJA AGAIN

If you dey on top social media for Naija, especially for South West, you go see say every where you look now, na so so Scream Awards go dey shine for your eyes, for facebook wall, for Dp on top BBM, for twitter plus instagram. Na beta award wey dem dey sama youths wey dey try for dem lane and dis year own wey dem call The Change is Here go shele next week thursday wey be October 29th for Ibadan, wey be unofficial capital for South West Naija. Dem don nominate plenty pipu for plenty categories wey dem get, so rush go dem website go find pipu wey you like go vote for dem, the site na www.screamawards.com.ng. Dem even nominate me too, you say for wetin, you go sabi wen you reach the site.

No comments: