Saturday, October 24, 2015

TRIBUNAL SAY WIKE NO BE WINNER O, MAKE DEM ARRANGE ANODA ELECTION FOR RIVERS

If na play make dem stop am o, cos tori wey dey reach we dommot for TPN be say Election Petition Tribunal for Rivers State wey dem arrange wen Dakuku Peterside halla dem say ojoro dey the election don yarn today. Wetin dem yarn be like joke but e fit no be o, dem say the election no pure, say ojoro dey therefore make Oga Nyesom Wike go relax first. I just dey reason wetin go dey shele for the mind of Mama Peace now as dem don fall him hand of her political pikin. When the election go come be, TPN go sama you whenever dem talk am.

No comments: