E be like say this 10 years mata no be small something o. I just dey reason am say na small parry like dat but the way celebs for ibadan dey rep the mata for social media dey make me re-think say the mata go big no be small mata. Na Dexterity plus dey celebrate 10years wey dem don dey decorate anything anything. Dem don change am for pipu wey dey do parry cos dem decoration go make you think say na heaven you dey. Dat na why dem wan celebrate take hail Baba God say he don do dem well. The parry gangan go shele for October 28th for Jogor Center wey dey Ibadan, na the hall wey big pass dem wan use o and na white everybody dey wear dat day. We say congratulobia to Bros Favour, wey be the chairmo and the Dexter wey dey inside dexterity.

No comments:
Post a Comment