Shebi una don see abi una don go plenty shows for inside UI, but e sure me die say una never hear open mic for inside UI before. Today today na him Mc Tootalk go make am shele for inside UI. Na comedy show wey go make sense gan cos the organizer, Mc Tootalk himself no well, he come still carry plenty comedians wey no well join body. Comedians like Dr. FRICK, Cris da Lecturer, ATM, G-jokes plus plenty others go dey and na Lafup go be MC, all the way from Lagos. So una see say no be small something. Make you turn up o. The mata go shele for Faculty of Art, Large Lecture Theatre (LLT). Gate fee na just 200, 500 or 1k as per say shoes get size. Time na 5pm so make una no gawk am o.

No comments:
Post a Comment