If you get luck waka pass UI you suppose sabi dis guy, Timi Olagunju, him name na Colossus cos the guy like big grammar no be small, infact he be like upcoming Obahiagbon but persin still dey understand am sha. Na Timi still be Hall Chair for Nnamdi Azikiwe Hall one year like dat, he like aluta things and he no dey carry last. Timi na my senior den and he be Lawyer, I remember say na him introduce me to Fashie Fizzie dat year. He don write one book before and now he don write anoda, dis time around the bros don vex cos he don release another book after he come back from USA where he go represent Africa for the Mandela Washington Parole. So Colossus no dey rerite for him ginger and thank God the hustle don dey pay. I believe say this him book go blow well well and the world go soon sabi wetin he carry. If you wan buy the book, go www.amazon.com make you go find YES AFRICA CAN by Timi Olagunju. Weldone boss.

No comments:
Post a Comment