Thursday, October 15, 2015

NA TODAY SENATE GO SCREEN ADEBAYO SHITTU AND AMAECHI FOR MINISTER

As the screening things still dey shele, yesterday na him BRF go show himself wey he turn himself to teacher dey lecture we senators with big big oyinbo grammar. The bros do well so tey, Naija pipu climb social media dey give am tuale and buate say he over sabi. And sharperly dem don pass am plus including many other pipu wey don show face for dem dommot. But today go still sweet as per say na today dem go tacke Rotimi Amaechi plus including Adebayo shittu wey be our own for Oyo State. So make una no gawk am o, the movie never end.

No comments: