Thursday, October 15, 2015

CHAI...DEM DON THROWAY BABA LADOJA MATTER FOR TRIBUNAL

Na so life reach? Dem say dem don throway Baba Ladoja mata against broda Isiaka Ajimobi for tribunal wey dey siddon for Ibadan yesterday o. Dem say na 5 judges siddon on top the mata and na Justice M. Saulawa be dem oga, na so dem say wetin the first court talk on August 18 na true, say na Governor Ajimobi win true true. So make Baba Ladoja no vex, make he dey go back home jejenly. Dat one mean say make Baba redial the number after 4 years be dat maybe he go enter.

No comments: