Nawa O, wetin Awoof go cause ehn.... So one of the comedians wey popular pass for Ibadan wey still be OAP for Lagelu FM, Rapindady, na him polongo on Monday dis week say he wan do one kain Awoof for him fans, the Awoof na to come follow am watch film for free, but to qualify, person go follow am for instagram, come like at least 30 of him pinshures, wetin come burst kasala na the part wey he put for bracket say na for ladies wey dey stay for Ibadan alone O, and na 3 pipu go dey win every week. After Dat one he come still clear dem about him show wey dey come, THE SPARTACUS COMEDY SHOW, wey go shele for JUNE 5 for fun Factory Bodija Ibadan. But some guys no find am funny at all cos from dem comment on top him Facebook page, you go see say dem dey PARA, one of dem na Stardom Lee Yinkus say no gender equality for this mata, Rapindady na you Sabi O. Rapindady Neva respond sha but I believe he suppose do guys version too abi wetin una think?
No comments:
Post a Comment