Monday, October 5, 2015

MAKE UNA NO VEX, NA TEST TRANSMISSION WE STILL DEY DO FOR THE PIPU'S NEWS (TPN)

Abeg make una no vex say una no dey see our hand everyday as e suppose be cos na test transmission we still dey on top THE PIPU'S NEWS. If you notice, you go see say we don change we definition from "Nigerian Stories in Nigerian Tongue" to "We Celebrate Pipu, Places and things wey dey make sense plus we do Aproko" And dis na to let you know say you fit get column on top TPN, make you dey write about any particular thing wey you like..e fit be medicine, Law, fashion, entertainment, jokes, poem, business, economy, travelling, sport, relationship, sex etc. So if u fit do am and you go like do am...make you send your name, contact plus wetin you wan dey write to my email address: afoudalafta@gmail.com. But make you just dey bear with us as per say we never stable finish. Na Testing testing microphone we still dey do for now.

No comments: