No be small mata o, Tori yarn as say Election shele for ma Federal College Of Agriculture and the thing burst kasala as students begin dey trow bottel so tey dem gats halla police make dem show for everywhere. Na later we come here say na one of the students wey wan become SUG presido wey dem dey call hin name CORRECT be the cause of the gbege cos dem bin wan disqualify the guy say the result wey him dey use na Oluwole made, dat is to say na fake. But the students no wan hear o, just like Naija pipu no wan hear say Buhari no get result dat year, dem say dem no send o, if he get abi he no get. Wetin dem sabi be say na Correct win election. Dem school Oga don say na today, monday 5th October dem go count the vote finish.

No comments:
Post a Comment