Sunday, October 18, 2015

KEMI OLUNLOYO SAY NAIJA PIPU NO DEY SHOW AM LOVE, SO SHE DEY WAKA

Abeg help me beg am make She no go na....lol. The pikin of we former Oga Gomina for Oyo State, wey like trouble like monkey dey like banana, wey come like to dey burst kasala anyhow for facebook don throwey another one o. When she climb on top facebook, go rundown Naija government say dem no dey show her love, as she dey try reach dem still dey do her like say she be nobody, where as for her mind she believe say she be somebody. She sha be Journalist, pikin of Governor before before, she be Pharmacist join plus including other things. She sha don vex talk say she dey go back to obodo oyinbo where she first dey stay. So abeg make una help me beg Aunty Kemi make she no go say Naija need her.......lol

No comments: