We Presido for Naija, Oga Muhammadu Buhari yarn the full world yesterday say make we no reason am o say he go resign if Boko Haram no end dem gbege by December. When he dey answer questions for Aljazeera, na him dem ask am if he still think say him promise say he go finish Boko Haram by December still dey stand, he say yes na, no shaking. Na so dem ask am again if Baba go resign if to say Boko Haram no gree finish by December. He say make we no reason am at all o say him go resign...lol
No comments:
Post a Comment