Thursday, October 15, 2015

AFOUDA RELEASE HIM SONG 'I BELIEVE IN NAIJA" ONLINE TO TAKE CELEBRATE HIM BYDAY

Na 2012 I record this song and I even put am for inside my audio CD "STRESS BUSTER" wey I release July 2012 when i dey Law School. na last year i start to dey sample am on Space fm 90.1 where i bin dey work before dem pursue me. but many pipu dey tell me say dem like the song that na why i say make i put am online make everybody help me hear am...abi i sha no fit chop the song alone even if i dey chop the Cd alone. so this one na my byday gift to all of una. Somebody even say make i shoot the video, but i still dey reason am. shey make i shoot am?

DOWNLOAD BELOW



No comments: