![](https://blogger.googleusercontent.com/img/b/R29vZ2xl/AVvXsEjvSm5GkztpfoLTNTr9tJJoQ0S0GWD4ylS7IFpNg9-NgW9D67AIgZQJ7ORpKMaHuQxxFFdBRxej7kD6Ai6cArRhdB1nrEDFzsiysQh-UQY0ONONq5l38a48iUBMsqKrZ8WZGxsR09T2Zqk/s1600-r/HEADER.jpg)
Sunday, October 18, 2015
FAYOSE CATCH TRAFFIC OFFICER WEY DEY DRIVE PASS ONE WAY
Gomina Fayose don show himself again say he no dey take nonsense. Na so he go commission one road for Ado-Ikere-Iju road wey dem change to double lane. As he do finish wey he dey go, na so he shadow one Peugeot 505 car for Oke-Ikere Area wey dey pass one way. Na so he pack, say make dem catch the persin wey dey drive, wen dem catch am na one Mr. Alabi who dey work for Road Safety, wey dey go Ikere, and he say na the road wey no good for front make am go pass one way. Na so dem take seize the man car, carry am go Road safety office and Gomina say make dem collect money wey oyinbo dey call fine from am before dem release the car.
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment