MARK 10:17-30
Jesus wan begin travel wen one young man run come meet am, ask am one question 'correct oga wetin I go do to enter heaven straight away without delay'. Jesus con answer am ' Y u call me correct. Nobody correct o, na only God correct.
U sabi d rules n regulations na, u must not kill person, no commit adultery, no fap, no yarn wetin u no sabi for ya friend head, no do 419, respect ur mi-le n pi-le. The man con yarn, oga I don finish all dis rules n regulations o, I do everything complete without carry over. Jesus look dis man, hin like d man, hin con say, something dey miss, go biz all wetin u get, bring d money give d beggars dem, make dem dey alright, and u go see room for heaven stay den u show my side.
The man face change hin con Comot for jesus front hin no happy. The man get bar and better head. Jesus shadow round con look hin disciples say 'e go difficult for dose wey get ba to even reach d gate of heaven. The disciples shock but jesus still dey yarn dey go, my people to enter heaven hard o, hin dey easy for camel make hin pass thru sowing needle Dan for man wey Hoe ba to enter heaven. The disciples re-shock, dem con reason together ask, 'den who go con reach cut-off mark wey go go heaven. Jesus con answer, hin dey hard, not for God cos everything dey possible for God hand.
Peter con shout ' what of we na! we Don leave everything follow u. Jesus con say, I tell una for low key nobody wey leave hin house, hin family, hin land hin children wey no go see times hundred of wetin hin leave n still enter gbege too, even 4 dis time n 4 future. Many of una wey be first, go be last, n dose of una wey be last go enter first. FROM D PIDGIN BIBLE, OB'S VERSION. NB: not for fun. Share to ya loved ones. God bless u.
No comments:
Post a Comment