Friday, October 23, 2015

GHEN GHEN...NA TODAY DEM COMMISSION PETALS FM 102.3 FOR IBADAN

Ibadan just dey bubble dey go as plenty radio stations dey show face and all of dem dey hold dem side strong. Na today 23rd October dem dey commission another tear rubber station Petals 102.3 fm wey dey for Bodija Ibadan. Plenty beta pipu na him dey there go see as the mata be, the Gomina for Ondo State, Olusegun Mimiko dey there, the chairmo wey get the station himself, Yinka Odumakin plus him wife dey there, Jimi Agbaje wey follow Ambode contest for Lasgidi follow join, Na Broda Isiaka Ajimobi dey commission am gangan and the Mc for the mata na, Uncle Yanju Adegbite. The radio competition now no be shere shere o. Ibadan pipu don get plenty choice die. Na so e suppose be, kini so, we no dey carry last.

No comments: