Monday, October 12, 2015

BIGGA BOI....EDMUND OBILO DEY GROOVE FOR CHICAGO NI O

If na me nko? Edmund Obilo just shock us dis afternoon when he go throway pinshures again for hin facebook page. The bros no like to dey show himself, na codedly he dey chop life but i shock pass electric shock when I see him pinshure for where he pose for one street like dat for Chicago. You say how i take know? Shey una no see am for the signboard wey dey for him back ni? But all him fans just dey hail am o, say make he relax, take time chop the life of him head. Abi no be so?

No comments: