![](https://blogger.googleusercontent.com/img/b/R29vZ2xl/AVvXsEjvSm5GkztpfoLTNTr9tJJoQ0S0GWD4ylS7IFpNg9-NgW9D67AIgZQJ7ORpKMaHuQxxFFdBRxej7kD6Ai6cArRhdB1nrEDFzsiysQh-UQY0ONONq5l38a48iUBMsqKrZ8WZGxsR09T2Zqk/s1600-r/HEADER.jpg)
Monday, October 26, 2015
ALLELUYAH...BABA OBASANJO GET ACCIDENT BUT HR STILL DEY KAMPE
Make we dey hail Baba God say he no gree make accident kpain we Oga Presido before before, Olusegun Obasanjo. Tori yarn TPN say Baba get accident yesterday when he commot from the service wey dem do take celebrate 10 years wey him wife don die. Na so Baba run commot from there dey blow down dey go Lagos wan go for the parry of Baba Ijebu, Adebutu Kessington wey dey celebrate 80 byday. Na road dem dey wey the back taya for the car go burst on top motion, na so the car do like persin wey drink, scatter ground so tey e face where e for dey come. But no shaking, Baba dey kampe and he no woundjure at all. Na so Baba throway press statement take dey hail everybody wey show am love yesterday, say all of una do well.
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment