E beta make he come late dan make e no come at all. 6years after Wande Coal release him first album wey he call Mushin2Mohits, he don polongo say he don ready to throway anoda one wey he call WANTED. Everybody wey sabi beta music sabi say Wande Coal wey him guy name now na Black Diamond no dey dull at all. Even Tubaba talk am for time wey no too tey say na the guy be the Naija Musician wey him dey feel pass. Since Wande yarn the full world wetin dey him mind, na so so jubilation him fans dey jubilate.
No comments:
Post a Comment