Friday, October 16, 2015

NA SO...OMO'YA SHINA FOR SPACE FM SAY MAKE WE DEY EXPECT HIM ALBUM LAUNCH

Na yoruba adage talk am say one road no enter market, na him make Police man dey do tailor join. Olushina Olabode na yoruba presenter wey dey work for Space Fm, and na him be the Head of Yoruba Entertainment for the station cos he dey anchor programmes like KO MA ROLL, ROKEKE wey be entertainment programmes. Na so he just throway art work for social media yesterday say him go soon launch him album o. And from wetin dey on the poster pipu wey go dey there na Yinka Aiyefele, Abass Akande Obesere, Femo Lancaster, Femi Solar, Alhaji Taiye Currency etc. Maybe dem go come song for the album, na him we never know but e sure me die say him and Femo Lancaster sing one song for inside the album. Na December he go launch am but he never yarn us date plus venue. We dey expect o.

No comments: