Na
wa O, shebi dem yarn us dis week say Senate don start probe for we power sector
and dem carry am from the time wey Obasanjo dey office, come reach the time wey
YarAdua and Jonathan dey office.
But na like electric shock wen we hear say Baba Obasanjo go block we presido for Aso Villa where dem enter dommot go do meeting and dem no gree tell pipu wetin dem yarn for the meeting. But some pipu say na report OBJ come report for Buhari the message wey him send am to Guinea Bissau. Na dat one dem no come fit yarn for public? I just dey ask o!
No comments:
Post a Comment