Wednesday, September 9, 2015

POLICE CATCH PASTOR WEY TAKE TIPATIKUKU CHOP 16 YEARS OLD GIRL OGBONO FOR 3 DAYS


Pipu wicked sha, police for Lasgidi don catch one yeye pastor, Abraham Sunday, who be pastor for one Christ in All Nation Church for Adalemo say he take by force chop the ogbono of a 16 year old girl wey be pikin of him family friend.

Tori yarn us say the girl dey sick, na him she go hospital o, na when she dey come back she eneter the same danfo with the agbaya wey yarn am say him go carry her go for deliverance. Na so he go camp the girl for him house o, for 3 days dey chop her dodo anyhow. Na the Pastors neighbors reason am say he be like say yeye dey smell and na dem go report for one NGO wey call police for the pastor. When dem carry the girl reach hospital dem confirm am say the pastor don thief the girl Ogbono chop. Nawa O!

No comments: