Tuesday, September 8, 2015

WETIN UNA DEY FIND AGAIN,NA 4 TIMES NOW I DON POLONGO EVERYTHIG WEY I GET- BUHARI PARA


Make dem no provoke our Presido o. President Buhari para for some journalist wey dey take yeye question frustrate am for Accra Ghana. He say wetin na, I remember well say na 4 times now I don polongo everything wey I get. When Murtala Mohammed enter power in 1975 dem say make we declare that year abi no be so?


He say anybody wey think say him don do magomago make he waka go where he suppose go, go do the right thing say make dem give am everything make he see for himself say him no dey lie. He say instead make dem do that one nko na him dem wan take question kill. Baba no vex jare.

No comments: