Shebi pikin wey say him mama no go rest, him too no go sleep.
Na him make the youth for Ohaneze ndigbo dey warn popular Lawyer, Festus Keyamo
say make he take him time o. The warning na him follow wetin Keyamo yarn say
Pipu wey dey complain say Buhari no appoint dem tribe na Ebinna ’I never chop”
wey just dey make noise anyhow.
Ohaneze Ndigbo come dey warn am say make he no take dem
score goal o, cos dem know say na post he dey find for Buhari hand wey make am
dey yarn opata, and make the guy reason am well o say he no make brain for one
man to reason am say him fit fight one full tribe. For that reason nko, dem don
tell am make he come beg them o, make he beg dem make the full world hear am or
else…….
Or else wetin? Me I no know o!
No comments:
Post a Comment