Friday, September 18, 2015

WELE GBOMGBOLO, WELE GBAMGBALA...NA SO CRAZE DEY START...SEE DENRELE O

When MI sing that song that year e be like say he don see vision to Denrele ni o, cos the new photos wey the bros abi na the babe make we call am now, release be as e get o. Na so he don turn woman finish come still dey pose like babe. Many pipu dey call am the Caitlyn Jenner of Naija...walahi the bros mata no gree me talk cos he don dey confuse me. I bin dey argue before san na just him own concept wey he take dey chop him daily bread be dat but e be like say this play don dey turn for real o...I sha cover my Y**sh with the blood of God.

No comments: