Friday, September 18, 2015

WE NO DEY FIGHT O, OSINBAJO PLUS EL-RUFAI SNAP PINSHURE TO STOP RUMOUR

Na anybody get mouth wey he dey run anyhow, but sometimes persin suppose try stop some pipu mouth. Na so we vice president Prof. Osinbajo plus Kaduna State Governor El-Rufai go snap pinshure together to stop the rumour wey dey circulate say 2 of dem dey fight after El-Rufai insult am for one meeting wey dem do and we presido siddon dey look, no try caution El-Rufai but now dem don snap pinshure say dat kain thing no shele, na super story.

No comments: