Tuesday, September 22, 2015

SHETE SAY MAKE WE COME CHOP ILEYA MEAT FOR HIM NECK COS NA HIM REDEZVOUS

One of the comedians wey tall pass for Naija, Shete wey take Ibadan do him dommot don dey polongo o, say make the full Ibadan come chop ileya meat for hin neck for Ileya day. Although from tey tey, me don dey personally suspect say he get dream say one day he go do poiltics, cos if you see the pinshure wey he dey put for facebook, na like politician he dey pose. So I no too shock when he start to dey polongo say him show Rendezvous with Shete go shele this thirsday for Options 247 and plenty artistes go dey there to follow am do the runs...meanwhile the main, the main, wey he call High Definition na still November. Oya na, lets go there.

No comments: