
Tuesday, September 22, 2015
OGINI BERNARD DON SIGN DEAL TO CARRY HIM HAMLET IN PIDGIN GO TOUR
Na true say one day one day e go beta, wen hustle go begin pay persin...that na the tori of Ogini Bernard wey him pipu still dey call World Best. If you never watch that him play Hamlet in pidgin, you don jonze. Although no be him write Hamlet gangan na Baba Shakespeare write am from tey tey, but sha him don tushify the play, carry am enter Naija wen he translate am to pidgin and the play dey sell like Akara and Bread for Ife junction. Na him dem see for Lake Show Media wey make dem follow World Best enter agreement to carry the play waka wey oyinbo dey call tour. According to World Best, he say after the tour, him go come relaese the play enter market. Laff wan kill me die wen I watch day play for UI theatre Arts dat year. We say congratulobia to Ogini Bernard. As hustle don dey pay na Godwin.
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment