Saturday, March 19, 2016

ADONBILIVIT... SEE HOW OLD OMOTOLA MARRIAGE GO TURN DIS MONTH





Omotola Jolade Ekehinde marriage go complete 20yrs on 23 of dis month wey we dey so nd d actress on her instagram page tok sey she dey hapi nd she dey thank Baba God sey Him keep her marriage till dis time. She com post d picture wey she nd her husband take 20yrs ago nd she write on top ham sey her husband tell her make she pack her tins for 5days trip 20yrs ago,

he no tell her where dem dey go until dem enta private jet wey take dem go Côte d'Ivoire for their honeymoon, she tok sey she hapi well well sake of sey na dat time be d first time wey she go enta jet nd d tin wey totori her body pas dat time be sey na her husband naim fly d jet. She tok sey now o for their anniversary again d man don tell her make she pack cloth for 10days trip nd she neva knw where d man dey take her go bt she dey hapi, make I quote her "#I am still wondering where he is flying me to for our anniversary bt i am exited #countdowntomarch23rd #20yearsmarriage anniversary... Congratulations ma'm...

No comments: