
Sunday, September 27, 2015
KAYO WEY GET KAYO CLOTHING FOR IBADAN DON DEY TURN GODDESS FOR HER KINGDOM O
This babe sha, she sabi package die. Na she be oga Tailor for Kayo Clothings, as per say na she gangan be Kayo, e be like say na Kayomikun her Papa and Mama give am before she come tushify the name for herself by herself. I hear say the babe don vex turn her office to another thing patapata cos the place don fine die...and she just confirm am with the pinshures wey she dey share for her social media pages. Koko of the mata be say the babe dey try and she dey try wella. Make I no forget yarn you say she still be model o. You fit reason dat kain thing? Na she dey sow cloth, na she dey model am but that make up sha na from DEX make over. The pinshure make brain die and the babe try wella.
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment