
Tuesday, September 22, 2015
FINE BOY COMEDIAN, AROLE DON VEX ENTER ROAD O AS HE POLONGO HIM WOLI AROLE SERIES
As e be like say the jungle don dey mature and no time to slow down, pipu wey get brain no dey rest, na so so new things dem dey reason. Dat na why I happy wen I see say one of we brodas, Arole, wey dey make brains for comedy don climb on top social media dey polongo him tear rubber ochara work, Woli Arole Series. Make una no forget say na dis badt guy win the second edition of Ali Baba Spontaneity Competition. And he don promise say dis one go make all of us laff like persin wey chop lotto, but he never tell us wen make we dey expect am sha. But anywhich way make Baba God no kill us, we go siddon wait for am. Make him throway, make we catch am.
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment