Wednesday, September 9, 2015

NAWA O, DEM KIDNAP PIKIN GO TAKE AM BUY SOFT DRINK FOR LAGOS



Wetin we no go hear for this country o, na so one bad sharp guy, Jonathan Cooker go waylaid 8 year old pikin wey dey come from lesson for Lawrence Street in Lasgidi. He carry the small pikin come carry am go deposit for where he go buy soft drink wey dey go like 51,000 Naira.

The guy say he dey come make him junior broda stay, na so the person wey dey sell market gawk am too. But as God go do am, he never waka far wen one persin wey sabi the pikin see am ask am wetin he dey find. Na so the pikin point am say na him carry am come the place and as the guy see say e be like say him scope don fall, na so he pick race but trust Naija pipu now, dem chase am catch come carry am go dash police. Pipu wey dey sell market no dull yourself o!


No comments: