As
the time for the Oga patapata for UI wey dem dey call VC, Prof. Adewole don dey
over, tori wey never done finish wey show face late yesterday nite show say e
be like say dem don finally pick persin wey go climb the big chair after him.
If the rumour na true, na him be say na Prof. Idowu Olayinka carry the cup o. Cos the thing be like battle o, 12 pipu wey dey fight for the mant don do debate, do many many plenty tinz for inside the school to know who the oracle go pick.
Before now, na Prof Olayinka be the second oga for the school, wey dem dey call Deputy Vice Chancellor (academics). But na still rumour sha cos dem never put am for dem website for UI.
No comments:
Post a Comment