
Sunday, September 27, 2015
NASO...DEM DON SAMA WE BETA PIKIN SUNDAY EDWARD ONE BETA AWARD.
If you dey waka well and you don tey for Ibadan music and you no sabi Sunday Edward, wey him guy name na Bros Eddy, na him be say you no dey follow professionals work. Dis bros sabi wella for anything music plus including sound, him music studio wey dey Odo-ona elewe don turn house for many of we popular musicians for Ibadan, pipu like Adetoun, Yetunde Are and even Babatunde before he jand. Dat na why I happy well a wen I see am put am for him facebook page say CSR Nigeria plus including TOTAL Upstreams Nigeria gather sama am better Award. You say the award na for wetin? Na for fighting corruption...if that na wetin I tell you say he dey do. Congratulobia Bros Eddy!
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment