
Sunday, September 27, 2015
INSPIRATION FM DEY DO BETTER FOR WE LEAGUE O AS DEM DEY GIVE OUT 3SC JERSEY
Na so e suppose be na, we own na we own. Why oyinbo pipu no dey wear Eyinba jersey, wey we go dey fly dem own colour anyhow. Dat na why I too happy say Inspiration fm for Ibadan here dey promote we league as dem dey share Shooting Star Jersey give pipu wey win on top dem sport programme for inspiration. That one make brain die and we sama dem beta gbosa, if other stations go fit do like dis ni, e for too make sense, make dem stop to dey share fake Arsenal and Chelsea plus Man U jersey. For that foto na Alabi Ademola, dem GM for Inspiration Oga Lawrence Olisa, the lucky guy wey win the jersey, Chigozie Victor Plus including Dapo Okunubi wey dey present the programme for inspiration fm 100.5 Una do well.
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment