
Ahusubilahi...make God save us ni o, dem say na like 717 pipu dem don match kpain for Mecca again o. As per say Hajj still dey go on, and all the plenty things wey dey shele for there still dey shele, na like electric shock we shock o, when we hear say plenty pipu don still kpain. Na last week we hear say crane fall wey kpain plenty pipu plus including 6 of we pikins for Naija. We pray o, make Baba God help us stop dis kain bad thing.
No comments:
Post a Comment