
Thursday, September 24, 2015
D'BANJ DON STILL BECOME SLOT AMBASSADOR FOR NAIJA
Broda mi Dapo Banga Lee don still do beta for himself again as dem don make am ambassador for slot again. Slot na one company like dat wey dey sell beta phone. As dem make am Ambasaddor dem come still sama am one beta car wey dem dey call Porsche Panamera. Dem say broda mi still share him Koko Gari for stage after dem introduce am give pipu finish. Bros I envy this your beta head o, make some pipu siddon for there dey cry say you never sing hit song, dem go tell me when last dem pay for hit song for this country. Congrats jare Eja Nla (Oga Titus)...lol
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment