Thursday, September 24, 2015

JUNIOR AJAYI FIT DON COMMOT O, BUT OLUYOLE WARRIORS NO DEY SHAKE

If one persin no go, another persin no go show abi he no go come. Na so God arrange life, Junior Ajayi who be striker for shooting Star, wey still don play for Under 23 for we national team, don waka, as God don answer him mama prayer and dem don sign am for CS Sfaxien, one club wey dey Tunisia. But even as he commot, God still dey our back gidigba and we no go slow down at all, na so him padi for inside shooting star, Nojeem Oluokun yarn wen he dey yarn with www.footballlive.ng he say nobody big pass the club o, na the club be the oga patapata. So we wish Ajayi all the best and for we club. Up Shooting! Shooting for life.

No comments: