Monday, September 28, 2015

BAYO FALEKE OF FRESH FM DON CARRY AWARD AS PERSIN WEY SABI READ YORUBA NEWS PASS FOR YORUBA LAND

Anytin wey you sabi do, my broda, my sister do dull am o, do am like say na him dey keep you for life. And wen you do well, Baba God and even pipu go come dey feel you, dey do beta for you. Bayo O! Wey become over popular when him dey Splash fm dey do tifuntedo but now he don dey play for Fresh Fm FC...lol. He don win award o, no be today sha but this one na from The Association of Yoruba and English Poets for Yoruba Land and dem sama am the award say na him sabi present Yoruba news pass for yoruba land. But I like the Bros sha, he don quickly climb facebook go dash Baba God the award cos according to him na Baba God be him ginger ginger intellectual ganja. Congratulobia bros....you do well.

No comments: