Friday, September 11, 2015
NO BE SMALL GBEGE O, P SQUARE AND SOUNDCITY DON VEX
No be small katakata na him dey burst for the dommot of P Square and Soundcity o. Tori yarn us say the 2 mouthed pipu don enter the same trouser dey fall dem hand on top social media. Na Peter from P square we hear say he first send tweet say Soundcity no dey gree play dem videos again. Na later aproko come say na becos say dem bone one soundcity event na him make soundcity bone dem videos as per do me I do you. Dem bros wey still be dem manager come carry the mata go anoda level wen he go tweet say Soundcity no dey try cos dem no wan pay dem shishi for the show ni. The season film still dey continue sha. God go help dem quench am.
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment