Monday, September 7, 2015

AIYEFELE’S FRESH FM DEY VEX O, DEM DON CARRY EVERYBODY FOR RADIO FINISH


No be small mata o, Fresh FM, the station wey Tungba master, Yinka Ayefele just open no wan hear at all o. Na vexnation dem carry enter Ibadan market and dem wan yarn everybody say dem no come sell gugury for Ibadan, dem really mean business because the people wey dem don carry wey go dey work for dem no be small o, e no get how you no go be fan of one of dis pipu.


Na on September 1st dem start fully o and the pipu wey we hear on top the radio dey show us say dem no dey smile at all. Rolake Bello and Femi Egunjobi  dem move dem from Star FM, Bayo Faleke and DJ Nuu dem move dem from Splash FM, Bolade Salami and Soul, dem move dem from Oluyole dem no stop for there o, dem even waka reach Lagos go move Mspyce and dem even move dem General Manager, Dj Flexxy (Pekun Oloyede), who be former former GM wey start Splash FM fm,  dem move am from City Fm Lagos. Wow….see say dem dey vex gan, make we siddon see as dem go deliver the freshness wey dem promise us.

1 comment:

Unknown said...

Nna men, no be small vex ooo, e remain make dem enter abuja go carry more.