Monday, September 7, 2015

YORUBA PAPER REVIEW DON TURN GBEGE FOR IBADAN…SPLASH FM vs INSPIRATION FM vs FRESH FM


No be small mata o, me sha dey like the way e dey go sha. Ibadan pipu like news paper review no be small and all the radio stations don know so dem dey plan dem come. Before now splash fm don siddon on top radio from 9am to 10am, Monday to Friday with dem Tifun Tedo. No body for Oyo State fit talk say him no dey enjoy the programme and all the pipu wey dey present am, Before before na Folake Otuyelu and Abolade Salami before Kola Ladoke and Bayo Faleke come join dem, den Abolade Salami commot go oluyole FM.


Recently sha, as new radio stations dey come na so dem dey package dem own Yoruba paper review come and the time wey dem come dey put am go show say dem wan collect the 9am to 10am from splash hand. Inspiration don vex go carry some Bros for the level wey sabi well well and dem call dem own, Kalekaako with dem MR. GRA and co for that same am. Na so Fresh fm too put dem own Ajabaale for 8:30am and na Abolade salami plus including Adebayo Faleke come dey do am, but sha dem don put some jara for dem own wey make am different small from the others.  So who go come win dis better war, make we siddon dey look. Elemi lo ma last!

No comments: