Saturday, September 12, 2015

AHUSUBILAHI…CRANE FALL KPAIN PLENTY PIPU FOR INSIDE MOSQUE FOR MECCA


Saudi Arabia say dem don start dey shine light on top the how a crane take fall for Mecca wey kpain like 107 pipu. Tori yarn us say the big crane wey be red colour fall enter the big mosque where pipu plenty dey pray. Dem say na plenty rain plus including heavy wind  fall the crane. 

Aproko say no be today wey dem don dey suspect dem constriction site for Saudi. The big mosque wey dem dey call The Grand Mosque or make dem call am Masjid al-Haram, na him big pass for this full world and na him surround the place wey holy pass for Islam wey dem dey call Kaaba. Na like 230 people woundjure for the mata.

No comments: