Tuesday, December 9, 2014

UNA POLITICIANS OWN DON DONE LIKE BEANS WEY SPOIL, PDP CARRY APC DEY DO YEYE  
PDP don yab APC no be small o, dem even call dem dirty basket, dem say many of the pipu wey win for APC primary na politicians wey dem own don done like beans, wey don expire.

From wetin dem write on top dem facebook page, na our Speaker for the House of Representatives, Alhaji AminuTambuwal,plus him padi, the former Oga for FCT, Mallam Nasir el-Rufai. The party say Tambuwal and El-Rufai, wey commot from PDP go APC and na for there dem win ticket to take contest for Governor for Sokoto and Kaduna States, PDP say dem be their own okrika, bend down select or Tokunbo. Other pipu wey dem mention na Governor Abdulfatah Ahmed for Kwara State, the former Oga Speaker for the House of Representatives wey still don become Katsina State APC governorship candidate, Aminu Bello-Masari say all of dem na from dem waste basket.
But sha Tambuwal say no mata how dem do reach him no go vex and him no go follow dem drag mata, he say na      only pipu wey no get home training plus common sense dey do dat kain gbege for public.


No comments: