Monday, December 8, 2014

NA SO QUAREL TAKE DEY START O, DAVIDO SAY NA HIM MAKE SHOKI BLOW




As Wizkid dey claim say na him make Saeon song, Boogie Down blow na so Davido too don talk am say na him make Shoki blow. No be say he just talk am sef o, na for inside song he talk am and wetin he talk don dey make some pipu blood dey hot.


Omo Baba Olowo dey for inside one new song wey him padi B-Red just release and na for him own side he talk am say na “she dey dance o…but she forget say na me make shoki blow ooooo”. Make we no forget say true him dey for inside Shoki Remix, wey dem release sometimes in July, where Lil kesh for feature am and Badoo, Olamide. The song really make senses gan and even Alhaji Orezi and Dr san dem do dem own version of the song. But sha o, none of dem don talk put for wetin davido yarn but dem goons don dey yarn o, some of dem believe say the guy just dey rhyme ni and some think say him wahala just too much ni, say he too proud.

No comments: