Police for
Lagos don dey fine one Gonfabi 50 years old man wey run commot from house after
he take by force chop the dodo of him own 14 year old pikin. Na last week
Tuesday the yaya man, Vincent Uzor do the bad thing for Ebute Meta Area for
Lagos, for the house where him dey stay with him second wife.
Tori yarn us
say the small girl mama don kpain 7 years ago and since dem na her granma she
dey follow stay, till time wey no too tey wen the grandma dey sick. Na so dem
come carry her follow the grandma to Ogijo Area for Ogun State, make dem come
dey go stay with one Aunty wey go fit take care of mama. Tori say na like 3
weeks ago the Aunt send am back to her papa say she wan travel, so na since dat
3 weeks ago she don dey stay with her yeye Papa. The girl say she shock o, cos
na for inside kitchen her own papa for go catch am do am strong thing, come
give am 500 naira make she take buy drugs, na the money the girl take call her
mama pipu but before dem show face the Gonfabi don run commot from house.
No comments:
Post a Comment