Monday, December 8, 2014

NA WA O…NA SOUN OF OGBOMOSHO PIKIN FALL 9ICE HAND FOR APC PRIMARY ELECTION





For Primary election wey APC do on Sunday, the bros 9ice wey bin dey sing but wan chuke hand for politics too don loose. And the persin wey beat am na Prince Akeem Oyewumi, the pikin of the King of Ogbomosho, the Soun. 9ice bin dey plan say he wan become Honourable for House of Rep in 2015, where he wan go represent Ogbomosho North/South/Oriire constituency.


But sha o, him pipu don dey halla say na lie the election no fit end that yesterday because of the kasala wey burst. Dem say na wen 9ice Local Government, Ogbomosho North wan begin vote na him the gbege start and na so dem gats stop the election. So according the the bros wey sing Gongo Aso, the mata never end o, cos him own pipu never vote.

No comments: