Lagos State Government don reward some of dem teachers wey
do well with cars and some other better gift better gifts for the 2014 education
merit award wey shele for Ikeja on Monday. Na so dem still do better for Pupils
and members of staff wey do well for the state o.
The Madam commissioner for education clear them sha o, say the
gift na to ginger dem swagger o, so dem go fit do well for dem work, and pipu
wey no fit collect now go work harder so dem troo go fit collect next year. She
say 9 out of the 57 pipu wey collect the award go dey compete with teachers
from other states later dis year for the President’s Teachers and Schools
Excellence Award wey go shele for Abuja.

No comments:
Post a Comment